One For Mum…

Abeg if una see my mama
Hail her well-well
Wash her well with grammar
Your boy don show her hell.

I don thief; I don lie
I don fight; I don bloody
I dey sick; I dey die
She cure all, mummy dey steady.

Na she dey call always
Sabi to pray like Jesus wife
Our house always in place
For us, she fit free her life.

Momsie no vex abeg
You try, na me no dey gree
Yet you carry me like egg
Despite my ‘ef up’, you still love me.

Mummy I don hold ground
Relax ya mind, no more sorrow
Mummy smile, make you dey proud
Your prayer dem, e don dey show.

Baba God I thank You o!
Abeg make she still dey…
Momsie your boy love you o!!
Happy Mother’s Day.

Dan Ochu-Baiye

Large. Curious. Reads a lot. Wild. Loves lions and tigers. Music. Gym. Hiking. Loud music.

This Post Has 3 Comments

    1. Dan Ochu-Baiye

      Thank you Kabir. Just began following you. Massive fan of your poetry. Radical style, keep it up!

      1. kabir gandhiok

        Thank you Dan, that’s very kind of you to say. I appreciate the support deeply. Following you as well, much enjoyed your poetry, I look forward to reading more. 🙂 Have a good day!

Leave a Reply